Full Lyrics
CHORUS
Na wetin I go give to thank you Papa?
You do me well o Ogbonge God.
You bless me nyafu nyafu eh Papa
I no know wetin I do wey you love me so
You butter my bread and you sugar my tea
You answer me when I call Papa
Almighty father you do me better.
The things wey you do e dey sweet me for belle oh!
VERSE 1
You shower me blessings, favour is my name.
My levels don change, favour is my name
You do wetin my mama no fit do,
Jesus na you biko Oga kpata kpata
VERSE 2
Me I be God pikin, my life e don better
Kata kata e nor see me o!
Papa you tanda gidigbam for my side oh
Your love and mercy for me yakpa.
Oh Jesus I thank you o!
I go dey serve you for ever more
You be Baba
VERSE 3
Thank you, thank you Papa I thank you
You be my helper eh! miracle papa
You shower me blessings, you give me strong body you open all my doors
Papa I thank you. Aiye!!
You love me oh na im make I say
You faithful papa
Since the time of Adam na im make your name
Be Ogbonge God
EKWELA KAM GBAR'AKA LA
E ji m akwa bia n'ulo Gi eh
Chim, ekwela kam gbara aka la
E jiri mkpa m bia n'ulo Gi eh!
Chim, ekwela kam gbara aka la
Remebere biko Nna doo
Ekwela kam gbara aka la