Full Lyrics
[Wise Man 3]
That star, that star
My friends una see that star we dey see
E mean say our king don come
Eh, our king don come, our king don come
Carry your load make we dey go
Carry your gift make we dey go
Make we go see our king
[Soprano]
You see that star, that star
You see that star e mean say our king don come
Come my people
Carry your load make we dey go
Carry your gift make we dey go
Make we go see our king
[Bass]
Papa, mama, broda, sista, my friend
Make we go see our king
[Soprano]
Mama, broda eh, sista eh, my friend
Make we go see our king
Papa, mama, broda eh, sista, my friend eh
Make we go see our king
[Wise Man 1]
My friend you dey see that star
Make we dey go, e go carry us meet our king oh
[Wise Man 3]
No turn back, no look side, just look front
Because we must, we don reach Herod palace
[Wise Man 1]
Oya make we stop
Our king go dey this palace
[Soprano]
Our king nor dey here
Our king nor dey here
Our king nor dey here o
[Herod]
My people una welcome
My elders una welcome
Wetin carry una come this palace?
[Wise Man 3]
King Herod we see that star
E mean say our king don come
We come pay homage
[Herod]
Dey here my people, e nor dey here
No new king dey this palace
If una see am make una tell me
Make I go pay homage
[Soprano]
Celebrate, make we dey celebrate
Make we dey celebrate, make we joli
We don see our king
[Wise Man 3]
We don come from far, we come see you our king eh
We don come with gifts, we see that star wey dey for heaven
We come pay homage with our gifts
With gold because you be king
[Wise Man 2]
With frankincense because you be priest o
With myrrh because of your death
Make we joli, we don see our king
[Soprano]
Celebrate, make we dey celebrate
Make we dey celebrate, make we joli
We don see our king
Come see our king