Full Lyrics
REFRAIN
Make we go, make we go to da house of God,
Make we go bow down before him.
I jolly when dem talk o, I jolly.
VERSE 1
Make we go to baba God house.
I jolly, for there our leg dey tanda
Gidigbam gidigbam eh,
For your dormot Jerusalem.
VERSE 2
Dem build Jerusalem as a
City wey dey kakaraka,
Na for there dem dey go up,
Dem wey be God people.
VERSE 3
Make we go to baba God house,
Make we go worship am before him people.
Oya make we sing of him beta things,
Make we bow before am and say to am thank you.